Saturday, 7 June 2014
HOW TO MESS IN PUBLIC (PLS DO NOT TRY THIS AT HOME)
To mess for public dey sweet but if dem catch u, no be small
embarassment o! Just follow dis guide lines and u are on ur way
to being a star in dis profession.
1. When u enter a hall, check d wind direction, if na closed hall
with AC, better. Maximum impact.
2. Make sure say u sidon face d wind direction. ...
3. Make sure say u get enough leg space. U go soon knw why.
4. Form ajebo by crossing ur legs every now and then.
5. U don ready to execute, try hold am until time wey d hall dey
noisy incase ur mess na d type wey dey sound like AK47.
6. Now carefully cross ur leg, right over left.
7. Elevate d right yansh lobe.
8. Release small (sound check).
9. If no sound, allow make d mess flow steady.
10. Allow time for proper circulation.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment